Sunday, 2 February 2014

David Moyes: Bad naim follow ManU

David Moyes sey na "BAD LUCK" naim make ManU nor win the game yesterday. Yesterday na d first time wey Stoke dey win them since 1984.

Thursday, 30 January 2014

1st 10 people to predict d match scoreline go win N500 Awuf Recharge Card

Oya cum predict and win free recharge card. Wetin you think sey go be the Match scoreline between Mancherster City and Chelsea? just do am like dis:

Manchester 2 - 2 Chelsea, if the game end like that and you dey among the first 10 people you dor chop our Awuf card be dat oooo.

Oya make una start to predict now.

Aguero dor injure again

Aguero dor injure again. Na wa for am oo na so so injure e dey injure self wetin shooo eim own too much. He just come from injury never reach 2 weeks e dor dey go again

Wednesday, 29 January 2014

West Ham suffer Chelsea badly

West Ham frustrate Chelsea so tey Jose Mourinho come begin slam them. Chelsea loose 2 point yesterday against West Ham when der draw with them. Chelsea opportunity to close the gap between them and Arsenal, West Ham nor gree give them. The game end for 0 - 0.

Nani agree for Inter Milan

Nani for ManU dor agree to go Inter Milan on loan till end of Season.

Manchester City Wound Spurs

Man.City hurt Spurs last night with 5-1. This guys there vex dis season, there just dey score goals like say na beans. This one mean sey home and away there score spurs 10 goals. Aguero na start d goal scoring follow by Yaya, Dzeko, Jovetic and Kompany their captain.

Ghana dor enter Final


10 men Ghanians remove
Nigeria from Africa Cup of Nation 2014. The game end for 0-0 draw, der come play extra time then for penalty Nigeria players just dey miss der penalty anyhow naim Ghana come settled down win the game to enter Final. Up Ghana!!!

PSG dor sign Cabaye for 24m Euros

PSG dor sign Cabaye from Newcastle United for 24m Euros for 3 and half years period