Sunday, 23 March 2014

Thursday, 20 March 2014

NIGERIA GIRLS BEAT COLUMBIA

Nigeria come from 1 goal down take beat Columbia 2-1 for the U17 cup wey dey go on for costa rica.

Goals from Joy Bokiri and Uchenna Kanu lift the Flamingoes to victory after the Colombians had taken the lead in the third minute through Angie Rodriguez.

VAN PERSIE DOR INJURE


Dem stretch van persie commot from field after him score hattrick against Olympiakos as dem qualify for the next round of UCL. Van persie wey score all 3 goals for Man utd. but him nor fit finish the match as the injury nor let am continue.

Moyes talk say the injury nor bad. like that, so make man utd fans pray make E come back quick..

Thursday, 6 March 2014

RONALDO DOR BECOME HIGHEST GOAL SCORER OF ALL TIME


Ronaldo dor become Portugal's highest goal scorer of all time after him nack 2 goals pass cameroon for world cup friendly.

Ronaldo dor score 49 goals in 109 matches for Portugal.

Ronaldo greatest of all time?

PUYOL: I GO LEAVE BARCA

Puyol dor come out to talk say him go leave Barca at the end of the season.

Barca go miss this great defender of our time?

Friday, 28 February 2014

DIEGO COSTA GO PLAY FOR SPAIN


Spain coach Vicente del bosque dor call diego costa for the friendly match against Italy on wednesday.

After many kata-kata wey him dor cause between Spain and Brazil, e go finally play for Spain. meanwhile chelsea striker fernando Torres nor make the list including him former team mate Juan Mata. Spain go play
Italy on Wednesday, all na to prepare their team for world cup. na the full squad be dis :

Squad in full:

Goalkeepers: Casillas (Real Madrid), Reina (Napoli), Valdes (Barcelona)

Defenders: Alba (Barcelona), Albiol (Napoli), Azpilicueta (Chelsea), Juanfran (Atletico Madrid), Martinez (Bayern Munich), Ramos (Real Madrid)

Midfielders: Alonso (Real Madrid), Busquets, Fabregas, Iniesta, Xavi (All Barcelona), Cazorla (Arsenal),  Koke (Atletico Madrid), Thiago (Bayern Munich)

Attackers: Costa (Atletico Madrid), Pedro (Barcelona) Navas, Negredo, Silva (All Manchester City)

Thursday, 27 February 2014

Ronaldo; Bale, Benzema and me, we too much





C baba dor come out to praise him entire team mates, he say dem really play well against shalke 04,  ronaldo scored 2 goals and asssist another 2 goals as dem beat shalke 6-1.
We have played some very good games this season and this was one more. Schalke were not at their best level. We are happy as we are now very close to reaching the next round."

Ronaldo admits he should have added to his double on the night after striking the post and seeing three efforts blocked by goalkeeper Ralf Fahrmann, but the Portugal captain insists he was simply happy to be back in action following his domestic suspension.

"I scored two goals but, as I said, the goalkeeper did well. I believe in my potential, my team-mates helped me and in the second half I was able to score twice," he continued.

"What has happened has happened, I was frustrated because I didn't deserve a three-match ban, but I'm happy now.

"We're now motivated for the derby [with Atletico Madrid], that's the main thing. We are Madrid and we'll try to win at the Vicente Calderon."

Friday, 21 February 2014

Mexico squad wey go face Nigeria





Mexico coach Miguel Herrera dor relaese him list of 24 players wey go play friendly match against Nigeria on march 5 for Georgia.

He dor invite 8 players wey dey play for europe come including Man Utd Javier Hernandez a.k.a Chicharito and villareal's Giovani Dos Santos come.

E still invite 16 players wey dey play for Mexico join.

The last time wey dis two teams meet d match end 2-2.

Both teams wan take dis match prepare for world cup.


Full squad of players wey go play against Nigeria

Goalkeeper- Jesús Corona - Cruz Azul, Moisés Muñoz - America, Guillermo Ochoa - Ajaccio
Defenders:  Paul Aguilar - Latin,  Enrique Pérez - Atlas, Juan Carlos Valenzuela - Latin,  Hector Moreno - Espanyol Barcelona, Rafael Marquez - Leon, Diego Reyes - Porto, Francisco Javier Rodriguez - Latin, Miguel Ponce - Toluca,  Layún Miguel - America 

Midfielders: Andrés Guardado - Bayer Leverkusen, José Juan Vazquez - Leon, Hector Herrera - Porto,  Juan Carlos Medina - America,  Isaac Brizuela - Toluca, Javier Aquino - Villarreal, Carlos Peña - Leon,  Luis Montes - Leon

Strikers: Giovani dos Santos - Villarreal, Alan Pulido - Tigers, Oribe Peralta - Santos, Javier Hernandez - Manchester United. 

Wednesday, 19 February 2014

Arsenal vs Bayern munich: Preview

 

Bayern munich commot Arsenal at this stage from champions league last season with away goals rule 12 months ago.Arsenal dey play bayern munich this night, the last time wey this two sides meet na arsenal beat bayern 2-0 ,  but Bayern qualify with away goals rule as the aggregate end 3-3.

Arsenal sitdown second for premier league, with only one point behind chelsea, and dey don enter quater finals of FA cup. dey still get 3 trophies to fight for.

Bayern dey unbeaten in 21 games for bundesliga, them don win 19 games and draw only 2, and dey also dey top their league with 16 points.

Guardiola know say na Bayern get upper hand for this match, but he nor wan use am take play.

The match go kick off 8.45pm Nigerian time.

Thursday, 6 February 2014

Wetin dey Happen to Messi

Our former world best player playing ability dor dey drop ever since Ronaldo win Ballon d'or na only 1 goal eim dor score and plenty Assist. Abeg wetin dey happen to am?

Sunday, 2 February 2014

David Moyes: Bad naim follow ManU

David Moyes sey na "BAD LUCK" naim make ManU nor win the game yesterday. Yesterday na d first time wey Stoke dey win them since 1984.

Thursday, 30 January 2014

1st 10 people to predict d match scoreline go win N500 Awuf Recharge Card

Oya cum predict and win free recharge card. Wetin you think sey go be the Match scoreline between Mancherster City and Chelsea? just do am like dis:

Manchester 2 - 2 Chelsea, if the game end like that and you dey among the first 10 people you dor chop our Awuf card be dat oooo.

Oya make una start to predict now.

Aguero dor injure again

Aguero dor injure again. Na wa for am oo na so so injure e dey injure self wetin shooo eim own too much. He just come from injury never reach 2 weeks e dor dey go again

Wednesday, 29 January 2014

West Ham suffer Chelsea badly

West Ham frustrate Chelsea so tey Jose Mourinho come begin slam them. Chelsea loose 2 point yesterday against West Ham when der draw with them. Chelsea opportunity to close the gap between them and Arsenal, West Ham nor gree give them. The game end for 0 - 0.

Nani agree for Inter Milan

Nani for ManU dor agree to go Inter Milan on loan till end of Season.

Manchester City Wound Spurs

Man.City hurt Spurs last night with 5-1. This guys there vex dis season, there just dey score goals like say na beans. This one mean sey home and away there score spurs 10 goals. Aguero na start d goal scoring follow by Yaya, Dzeko, Jovetic and Kompany their captain.

Ghana dor enter Final


10 men Ghanians remove
Nigeria from Africa Cup of Nation 2014. The game end for 0-0 draw, der come play extra time then for penalty Nigeria players just dey miss der penalty anyhow naim Ghana come settled down win the game to enter Final. Up Ghana!!!

PSG dor sign Cabaye for 24m Euros

PSG dor sign Cabaye from Newcastle United for 24m Euros for 3 and half years period